Kasala don dey plenti for West Bromwich Albion as de FA don finali charge dia strika Nicolas Anelka for de salute wey hin troway dat time West Brom bin jam West Ham for Premier League las month.
Plenti pipu bin vex for am say de salute dey yab Israel pipu and de FA sef don charge am now unda dia Rule E3 wey trap 'make pesin do any how or abuse pesin.'
Statement wey comot for FA website(www.thefa.com) bin yarn say:"we don tink am say de parade bad well well and as our Rule E3 tok as per to abuse pesin becos of God wey hin dey worship abi wia hin come from."

No comments:
Post a Comment